Thursday, 3 October 2013

PLANE CRASHES AT MMA in LAGOS this Morning !

Na Wa OOO !   My People, I Just hear Say Aeroplane
Crash for MMA After E Take Off ooo.
Them Say Na After a Few Minutes wey The Thing Fly commot For Ground Na Him the Thing Come Down ooo.. Some People Don Kpai for this Matter Wey Dey Make us Cry and Sad Now.
Make God dey Help us, Dey Guide Us For Everything we dey Do.. We Go Update Una with More Of this Tori and I Go post the photos from the Place Soon. We Hear Say Na Associates Airline oo wey wan fly from Lagos to Akure, we don confirm 20 people don die, Which kind thing be this ooo.  Na Wa oooooo! 

twitter: @nawaoooooo



Saturday, 3 August 2013

WIZKID ft WALE - DROP ( WIZKID DON FINALLY RELEASE SONG WEY HIM FEATURE WALE FROM YANKEE)

NEW SONG DON COMMOT O !
MAKE UNA HEAR AM.
THIS ONE NA WIZKID AND WALE AND THE TITLE NA DROP !!

Click Link to download Now:  http://youtu.be/kzDUF1KolXo

Saturday, 27 July 2013

NAWAOOO ! JUSTIN BIEBER DEY SPIT ON TOP HIM FANS SHA !



THIS ONE DON PASS WETIN PERSON FIT REASON SEF. WHICH NORMAL CELEBRITY GO STAND FOR UPSTAIRS, COME DEY SPIT ON TOP FANS WEY DEY LOOK AM FROM DOWNSTAIRS. I NO BLAME AM!, NA DEM WEY STAND DOWN DEY LOOK AS PERSON DEY SPIT ON TOP THEM, EVEN CARRY PHONE DEY SNAP DEM DEY LAFF DEM WITH HIM FRIENDS. THIS MATTER DEY VEX PEOPLE WELL WELL !!!

NAWAOOO!! - DOTUN COOL FM AND TAIWO OYEBANJO DON MARRY TODAY !!


                                     



Dotun Wey be Radio Presenter Don Marry Taiwo Oyebanjo. This One na Sweet Tori. Taiwo na Dbanj younger Sister o. We Go bring more Jara and Fisi unto the Matter. Na sharp Sharp Update be dis.

Sunday, 30 June 2013

Na Wa O ! Kim Kardashian and Kanye West Name Their Pikin "North West"

WHY PERSON GO NAME PIKIN WEY HIM BORN ''NORTH WEST''.
THIS ONE DON PASS NORMAL MATTER O. WHICH KIND NAME BE THAT,
SHEY THE PIKIN NA MIXTURE OF HAUSA AND YORUBA ? BECAUSE THIS NORTH WEST NAME E GET AS E BE O ! ABI WETIN UNA THINK ?

BRAZIL DON WIN OOO!.. ME SEF DON KNOW SAY NA SO E GO BE !



BRAZIL DON WIN THE WORLD CUP O !
ANYWAY, THAT TORI NO TOO CONCERN US JARE, I JUST SAY MAKE I SHARPLY UPDATE UNA AS E DEY GO UNTO THAT SIDE.

My People , Una Don Hear ? Ice Prince don win Bet Awards ooo!

This one na sweet tori oo. See as Ice prince dey make our head swell. Intact, na him and Tuface dem nominate sef. We thank God for our brother ooo, make e dey do well, dey bring all the better from obodoyibo.  My people make una follow ice prince celebrate oo! 

Nawaooooo! UNA DON HEAR THE LATEST TORI ABOUT TONTO DIKEH AND NDLEA DEM ?


I HEAR SAY NDLEA PEOPLE DEY PARA SERIOUSLY FOR TONTO DIKEH, UNTO SAY PERSON USE SKUNK WRITE BIRTHDAY MESSAGE TO HER O, DEM COME BACK AM UP WITH OTHER ONES WEY DEM SAY SHE DON DEY COMMIT SINCE. 
WELL, AS E BE SO, OUR FRIEND TONTO YARN SAY, SHE NO INVOLVE FOR THE SKUNK MATTER O, AFTERALL NO BE SHE POST THE PICTURE, NA HER FAN.
I WONDER WHY THIS MATTER DEY LONG O, EVEN DON DEY REACH JAIL TERM OF 15 YEARS MATTER.
MY PEOPLE MAKE UNA COMMENT, MAKE WE GIST ABOUT THIS MATTER O !. BECAUSE AS E BE SO, NO BE SMALL ISSUE O!.